Connect with us

Politics

BBC Interview: “To Be Underestimated Na Strong Weapon” – Akpata Assure Edolites Say E Go Win September 21st Poll

Published

on

akpata4

BBC Interview: “To Be Underestimated Na Strong Weapon” – Akpata Assure Edolites Say E Go Win September 21st Poll

Written By Oshiobugie John

Di leading candidate for di Edo Gubernatorial election wey dey come, Olumide Osaigbovo Akpata, under di Labour Party, don yarn for one interview wey dey circulate everywhere now with BBC Pidgin, say him don get correct plan to win di election.

For di trending video, dem ask Akpata, wey be di first NBA President wey nor be SAN, how e go take face him two major opponents wey don dey politics before dis election, as e be say dis na him first time for di political game.

Advertisement

“Me self, wetin I come be? I be like who nor hold my side? I be di immediate past President of di Nigerian Bar Association. Di guy wey you dey talk say dey APC wey win election, na five local government him waka round make dem vote for am. You know say to win NBA President for Nigeria, na 126 branches dey dat time, now we get 128 branches for di whole country, all of dem na lawyer. I run against two Senior Advocates of Nigeria, and I beat dem. I dust dem, I give dem better gap. To be underestimated na strong weapon,” Akpata reply di woman wey dey interview am, full of confidence.

Akpata confidence nor dey strange at all, because from di campaign videos wey we don see across Edo State and even outside, e clear say majority of Edolites dey stand gidigba behind am. Dem strongly believe say e get di capacity and capability to turn him vision into reality for a better Edo, and deliver solid results if dem vote for am massively for di September 21st gubernatorial poll.

Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x