Latest News
Meet Saliu Mustapha The Man Wey Everybody Say Go Be The Next National Chairman Of APC

Meet Saliu Mustapha The Man Wey Everybody Say Go Be The Next National Chairman Of APC
The PDP last month hold dem national convention and Dr Iyorchia Ayu come emerge as the national chairman of the biggest opposition party for Africa.
Dr Ayu na from North Central Zone, Benue State in particular, since when PDP do dem convention the whole attention of Nigerians don shift now enter APC body make dem see who the biggest Party for Africa wan produce as their next national chairman.
And we no suppose blame Nigerians for their concern because whoever go emerge as these two main political parties national chairmen must play dem own role towards Nation building.
The importance of the national chairman of the ruling party important well well and e good make we look into who go be the next party chairman for the All Progressives Congress, APC.
Today e get one man wey e b say na him b the talk of the moment, na him na every APC party stakeholder dey shout say na him dem want as their party chairman.
Make una come meet the MAIN MAN wey dey pull d crowd for APC, Mallam Saliu Mustapha the Turaki of Ilorin.
Why e b say this young man for APC dey pull crowd like this? Wetin APC members see for Mallam Saliu Mustapha body wey dem talk say na only him go fit to change the fortunes of the party for the beta.
From our opinion poll wey we gada across Nigeria on the popularity of Mallam Saliu this na d few things wey we fit put togeda so una go know why e b say na Saliu Mustapha dey reign for APC.
A very well accomplished and prominent politician, Mallam Mustapha was born on September 25, 1972 for Ilorin Kwara State. From when dem born am go reach now him don show the ability of better party administration.
He start him politics from the progressive flank, between 2001 – 2002, Oga Saliu Mustapa was the National Publicity Secretary of the Progressive Liberation Party (PLP) under the leadership of Dr Ezekiel Ezeogwu.
In 2003 Saliu come join hands with other strongmen wey get the same vision come register and form Progressive Action Congress (PAC), again the young Mallam still emerge as the National Publicity Secretary of the party.
Same year Buhari come out say he wan become President and Saliu Mustapha come key into Buhari vision, na there him come become a crucial member of The Buhari Organisation (TBO) and the Buhari Campaign Organisation (BCO) for some years.
In 2007, Saliu Mustapha come join hands with Buhari when he run under the All Nigeria Peoples Party (ANPP) platform to become president.
In 2011 Saliu Mustapha come join as a foundation NEC member for Buhari’s newly formed Congress for Progressive Change (CPC) , he first do Ex-Officio, and later he come become the party National Deputy Chairman under the leadership of Prince Tony Momoh.
After then him and Buhari come say make dem join hands with others to form the All Progressive Congress,APC. In fact to date dem dey hail Saliu as one of the signatories wey sign the merger agreement on behalf of CPC to create APC.
A great philanthropist wey don help plenty people across Nigeria, Mallam Saliu Mustapha get integrity, he get street credibility and na person wey APC members dey look up to say, yes he go bring back the great ideas of the original owners of APC wey start the party from the scratch.
The major thing wey make e b say Saliu Mustapha name dey ring bell for every Corner for APC na b say stakeholders talk say him no get baggage wey dem ontop he head.
According to these party members majority of the other people wey dey follow am drag for the chairmanship position don fist do governor and he good make the party try something else.
Dem say since dem form APC na only former Governors dey do the national chairman work, so this time around dem say e go pure if dem try another person, make dem see how the party go perform.
With the 2023 general elections fast approaching the APC would need to put its house together by electing a national chairman that would have a nationwide appeal and hit the ground running.
Nigerians are hopeful that the new leadership of the party would play a major role in meeting the expectations of the electorates as well as the masses.
These are some things you need to know about the most popular aspirant for the seat of the APC national chairman, Mallam Saliu Mustapha.
Credit Osigwe Omo–Ikirodah.
Source iReporteronline.
07032341798
-
Latest News1 week ago
Benin City Stormwater Scandal: How Obaseki Wasted ₦225 Billion Trying to Bury Oshiomhole’s Legacy
-
Latest News2 weeks ago
Old Taker. Still the Game Changer — Oshiomhole’s Legacy Rewritten in Real Time
-
Latest News6 days ago
Appeal Court Dismisses Akpabio’s Motions, Orders ₦100,000 Payment to Senator Natasha
-
Latest News6 days ago
Federal Government Warns Against Paramilitary Job Scam
-
Latest News7 days ago
Dele Momodu Drops Political Bombshell: ‘My Soul Has Left PDP
-
Latest News1 week ago
Ministry of Regional Development Empowers Port Harcourt Youths Wth Poultry Farming Training And Startup Grants
-
Latest News1 week ago
Air Force Personnel Dies Serving Punishment After Reporting Sick
-
Latest News1 week ago
Sanwo-Olu, Ooni Of Ife, GAC, Alake Of Egbaland Storm Tinubu’s Lagos Residence In Powerful Sallah Homage(Video)
-
Latest News2 weeks ago
Uyo Comes Alive as Ministry of Regional Development Launches Empowerment Program to Tackle Youth Unemployment
-
Latest News1 week ago
Hon. Minister Abubakar Momoh FNSE Joins Dignitaries In Owan To Honour Late Chief Raphael Arunah, Visits Hon. Kassim Ozeto(Video)
-
Latest News4 days ago
Road Reconstruction: Okpe Community Appreciates Momoh
-
Latest News1 week ago
Torrential Flood Ravages Oyo Communities, Leaves Millions in Damages