Latest News
Seven Solid Reasons Why Moses Na The Sure Plug For Etsako Federal Constituency
Seven Solid Reasons Why Moses Na The Sure Plug For Etsako Federal Constituency
Another election season don come again and Nigerians need to open their eyes well well make dem no go enter another armed robber vehicle for bad governance.
Why the country b as e b now na because of say the electorate no dey elect people wey good for them, and to know the betta people no hard only if we fit relax.
We must examine all these people wey dey talk say dem wan represent us for various elective offices well well before we vote them.
E get one South Ibie man wey dem dey call Moses Omo-Ikirodah(MODAH) wey wan represent Etsako Federal Constituency for Abuja.
Here na 7 reasons why e b say Moses don prove say him na the right person for the job.
1 Honesty:
Moses na very honest boy wey dem born for a humble Christian home, him na son to the Late Elder John Omo-Ikirodah wey dem know well well as a righteous man. Honesty dey MOSES OMO-IKIRODAH DNA.
2 Servant Leadership Representation:
Why most times we no dey get good representation for governance na because of say these representatives no dey reason say na to go serve dem people dem send them to go do for Abuja.
Once dem reach Abuja power go enter their head dem go begin disconnect with the people.
Moses get good communication relationship with his constituents, na person wey e b say if you call him phone and e miss your call e go call you back.
We need representatives wey na the people dem dey go serve and not for their own personal interest. Edo North must move forward.
3 Diplomacy
Moses na person wey e b say him sabi diplomatic relationship to take use sense achieve wetin e dey find. Current age legislator must sabi the skills to negotiate for him people and no be power dem dey use take pass bills na diplomacy and lobbying. Gra Gra no dey inside lawmaking.
Moses na diplomat.
4 Commitment:
Person wey no dey committed to anything no dey ever get result to show for him performance. Only when we begin elect committed leaders wey understand say na the people dem must work for then the beta for our democracy.
Moses dey committed to serving the people.
5 Be a Problem Solver
See Abuja no be where dem dey go add join our problem, we must elect people wey dey fit solve problems.
Moses na problem solver, him don prove am with him successful businesses and him foundation wey God don use am to solve people and societal problems.
6 Creativity
When you get creative lawmaker wey dey represent you , all wetin u go dey see na progress e go dey attract for everywhere, from education to health, infrastructure, empowerment, employment and other dividends of democracy.
Moses dey very creative and na the kind person we need now to represent Etsako Federal constituency.
7 Character
Most of our legislators dem no get single character, and to promote and defined our constitution you must get good character.
Moses get high standard of integrity and dey conduct himself very well for public.
Moses no get one single illegitimate business or baggage wey dey follow am upadan.
Your character must be reflected in your personal and family life; work and business and in your conduct as a politician.
Support and vote Moses Omo-Ikirodah for Etsako Federal Constituency.
-
Latest News7 days agoTinubu Govt Declares Nationwide Public Holiday For Nigerians
-
Entertainment5 days ago₦800,000, ₦5m, $11,000: Ogogo’s Daughter Accuses Nigerians Of Exploiting Father’s Cancer
-
Latest News1 week agoTinubu Meets Akpabio, Doguwa, Oyetola, Alake At Aso Rock
-
Latest News2 weeks agoINEC Makes Fresh Announcement After Declaring Adeleke Winner Of Osun Election
-
Latest News6 days agoAPC Chairman Collapses, D!es
-
Latest News4 days agoUzodinma Won’t Market Tinubu To Igbos’ – Oshiomhole Reveals Who Should Help
-
Latest News4 days agoTinubu Renews Appointments In NTA, NAN
-
Latest News2 days agoFG Announces New Appointment
-
Entertainment1 week agoOgogo’s Family Breaks Silence, Debunks Viral D**th Rumour
-
Gist2 weeks agoYour Uncle Adeleke Is The Real Arindin’ – Sowore Fires Back At Davido
-
Latest News3 days agoTinubu Reviews APC Campaign Council Over ‘Corrupt’ Names — See Who Escaped the Shake-Up
-
Latest News2 weeks agoOsun Election: INEC Gives Fresh Update As Voting Continues
