Latest News
Carry Us Dey Go….Carry Us Dey Go Our Promised Land- Edo Residents Jubilate Over Okpebholo/Idahosa
Carry Us Dey Go….Carry Us Dey Go Our Promised Land- Edo Residents Jubilate Over Okpebholo/Idahosa
Carry me Dey go, Jehovah carry me Dey go my husband house…
Shey una fit remember that hit song wey trend that year? Una sabi as the song sweet reach, na only the chorus dem dey sing from beginning go end. E be like say dem repeat am tire! As the song sweet that time, na so Edo residents dey hala now for Senator Monday Okpebholo and Dennis Idahosa matter for the September governorship election.
Na dis chorus dey reign now for Edo State… Carry Us Dey Go… Okpebholo Carry Us Dey Go Our Promised Land… Carry Us Dey Go… Idahosa Carry Us Dey Go Our Promised Land.
Everybody dey jolly dey sing for street, from morning till night, even mama wey dey sell akara for junction don turn DJ. Dem say make Okpebholo and Idahosa carry dem enter the Promised Land wey milk and honey go dey flow like water.
Dem believe say once dem enter office, na enjoyment go start, roads go smooth like baby skin, light go dey shine like Christmas for every corner, and water go flow pass River Niger. Na so dem dey jubilate dey dance, dey hope say their wahala go soon end.
Na we belief be say, as Okpebholo and Idahosa don join hand, two heads better pass one. Edo people dey talk say, “When hand join hand, e fit break kola.” Na the faith wey we get for these two men be that. We dey believe say, “Person wey get big yansh no dey sit for corner,” Okpebholo and Idahosa go stand gidigba for we matter.
So as e be like this, no dull moment for Edo State o! Everybody don ready, Dem don ready, na Okpebholo and Idahosa dey enter government house. Carry Us Dey Go… Okpebholo Carry Us Dey Go Our Promised Land… Carry Us Dey Go… Idahosa Carry Us Dey Go Our Promised Land.
Edo people dey hail dem, say “Cow wey no get tail, na God dey drive flies for am.” We trust say God go use Okpebholo and Idahosa take clear all our suffer suffer. Na so we dey, na so we believe.
Wow, see solid endorsement from the people of Edo State. The real question now be say, APC fit sustain am so? Make we observe the matter, see how e go play out. E be like for these people eye, na Dennis Osadebe Avenue straight. Well, make we observe and see wetin go better for Edo people wey show support.
My name na Osigwe Omo-Ikirodah, and I dey serve as the Principal and CEO of Bush Radio Academy.
-
Latest News2 weeks agoOlisa Metuh, Tunde Rahman, Abike Dabiri, Others Appointed As Tinubu’s Renewed Hope Ambassadors
-
Latest News1 week agoTinubu Seeks Senate Approval For Darma As Minister, Yuguda As CBN Deputy Governor
-
Latest News4 days agoAPC Elders Back Tinubu, Namadi, Acquire ₦150 Million Nomination Forms
-
Latest News2 weeks agoTinubu Greenlights New Police Academy Campus, Releases ₦15B Boost
-
Latest News1 week agoTinubu Announces Major Shake-Up In Education Sector, Releases Full List Of New Appointments
-
Latest News1 week agoCourt Grants PDP Factional Chairman Turaki ₦100m Bail
-
Latest News2 weeks agoSenator Abbo Quits ADC In Sh*ck Political Move
-
Latest News17 hours agoTinubu Appoints Former Power Minister As Special Adviser
-
Latest News4 days agoThousands Of Borno Youths Raise ₦38.5 Million In Massive Show Of Support For Ali Ndume
-
Latest News2 weeks agoADC Crisis Worsens As Binani Allies Defect In Adamawa
-
Latest News3 days agoSenate President Akpabio Declares Jimoh Ibrahim’s Seat Vacant
-
Latest News1 week agoOpposition On Edge As Supreme Court Delivers Crucial Rulings On ADC, LP, PDP Crises Today

