Connect with us

Latest News

Before 4pm On Election Day Dennis Idahosa Would Be Declared The Winner For Ovia Federal Constituency 

Published

on

299984704 627751005376624 7046286970634768141 n

Before 4pm On Election Day Dennis Idahosa Would Be Declared The Winner For Ovia Federal Constituency

My people election time don reach again oh, and the people don say dem dey wait gidigba for politicians make dem pay dem back in their own coins, for some  dem don talk say na beta pepper dem go show dem, then for others dem say because of their marvelous works dem go reward dem for re-election or 4 higher office.

You see Government na about service to the people and meeting the people’s expectations, electorate wey carry go stand under hot sun or rain go vote for person no mean say dem be mumu o, na their civic duty dem dey perform.

So recently we come go take sample analysis for Ovia Federal Constituency make we see who the people wan vote 4 for House of Reps and the many answers wey we get no surprise us at all one bit.

Advertisement

Out of 100 people wey we carry this question ask 90% say na the present lawmaker wey dey represent them for National Assembly dem go vote, he name na Dennis Idahosa. Ordinary this one no shock us but one comment wey one Osaze Osemwegie talk na shock us, he say before 4pm on Election Day INEC go don declare Dennis Idahosa winner.

Him reasons na say Dennis Idahosa don surpass everybody for the race in terms of capacity building, human capital development, employment and infrastructural drive.He give good reasons why nobody go fit win Dennis Idahosa.

He say PDP as a party fit no even get candidate for that seat for Ovia because of the crisis wey wan tear the party party and like this so e no get any other contestant wey don even near Dennis  in terms of pedigree and performance.

Hear wetin him talk, “Are we still on this subject matter on who would win the election? The truth is that Dennis don perform so well wey even the blind dey see wetin he dey do, he has made governance look so easy like ABC and make I tell you Dennis go win the election outright, before 4pm on Election Day INEC go declare winner, na me talk so , if anybody no like am make e go hug transformer”

Advertisement

That was a huge endorsement and shows a lot of confidence on the part of the electorates. Anyway for the things wey we don see and cover e b like true true Dennis no get mate for the race o, him projects include numerous schools, health care facilities, electrification projects linking over 82 communities, provision of portable water across all communities, solid skills empowerment programs and so many more.

If we say make we bet we no go lie give you all our money we go put am for Dennis Idahosa head because the young man don too try, go him Facebook Page Hon. Dennis Idahosa make you see the kind ogbonge works wey d man dey do and make you read comments, person wey dey work as if na Governor him be.

So make we still sef hear from you, who una think say go win una House Of Reps seat for the locality wey una domicile? Send replies to ireporteronline@gmail.com no worry if you bio want make we mention your name we go keep your identity secret.

Osigwe Omo-Ikirodah is the chairman and CEO of Bush Radio Academy.

Advertisement

Source iReporteronline.

320395746 828397828224582 1974691400165948122 n 1

 

Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x