Entertainment
Party Scatter: Tinubu Set To Give PDP Wotowoto As He Begs Supporters To Lower The Temperature Till Kickoff Of Campaigns (Videos)
Party Scatter: Tinubu Set To Give PDP Wotowoto As He Begs Supporters To Lower The Temperature Till Kickoff Of Campaigns (Videos)
The APC presidential candidate, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu don finally cut rope as him don read the riot act to the opposition, Tinubu wey dem say e head no dey house don ready prove to them say really this election matter him ready for dem no b small.
Yesterday Tinubu and hin running mate ,Kashim Shettima attend the APC Northern Speakers Forum’s unveiling of the Logo and Campaign vehicles for their door-to-door campaign and na there Tinubu begin fire from all cylinders.
Hin, first of all, beg him supporters make dem lower the temperature say time to begin caste everywhere for campaigns never reach. E say when time reach dem go know “WETIN TIME DEY TALK”, according to am dem be professionals of progressives, wey all dem sabi na Talk and do.
You know Tinubu sabi grammar, see how e take put am ” Lower the temperature, It’s not the time to campaign yet, they will hear a lot from us….WE ARE THINKERS AND DOERS”
Then for the PDP matta, Tinubu finish dem kpatakpata, e say dem (APC) go dig grave for PDP bury dem put, i.e Late PDP of blessed memory. According to am dem no b equals at all, we are smarter, we know the road let them follow. Tinubu mouth sha, e still talk say PDP dey confused say months to election dem still dey drag for leadership of the party, e say dem dey find direction.
We don first talk am say this election no be beans na for those wey get mind. Kikiki Asiwaju mouth no good oh.
Check out the video below and some pepper dem photos we dey cause vawulence everywhere.
Osigwe Omo-Ikirodah CEO and Principal Bush Radio Academy.
-
Latest News1 day agoTinubu Announces New Appointment, Sends Nominee To Senate For Confirmation
-
Latest News1 week agoPresidency Moves Against VDM Over Fake Tinubu Audio Allegation
-
Latest News4 days agoShake-Up At CBN: Deputy Governors Redeployed, Full List Released
-
Politics1 week agoWike’s PDP Camp Unveils 2027 Presidential Candidate
-
Politics3 days agoJune 12: Tinubu Set For Nationwide Broadcast, NASS Address
-
Politics1 day agoWike Clears Air On Chinda, Says INEC Candidate List Drops In July
-
Politics2 weeks agoBREAKING: Tinubu Sweeps Zulum’s Ward With 2,175 Votes In APC Primary
-
Politics2 weeks agoAPC Drops Full List Of Lagos Assembly, Reps Candidates For 2027 Elections
-
Education1 week agoNELFUND Refutes Claims Of Suspending Students’ Upkeep Allowance
-
Politics1 week agoGanduje Fires At Kwankwaso: “He Was Once My Political Boy
-
Latest News1 week agoJibrin Breaks Silence On Dumping Kwankwaso For Tinubu: “It Wasn’t Betrayal
-
Politics2 weeks agoWhy We Denied ADC Access To El-Rufai — ICPC Speaks Out

