Connect with us

Politics

Wike Pepper Dem Dance Steps At Chief Of Staff’s Office:Giving Haters A Fresh Dose Of Tears (Video)

Published

on

photo 2023 12 08 07.19.29

Wike Pepper Dem Dance Steps At Chief Of Staff’s Office:Giving Haters A Fresh Dose Of Tears (Video)

“Pepper dem Bolanle, pepper dem oh! Who no like better thing? Bolanle like better thing, she too like better thing. Who no like better thing? -Zlantan Ibile.

Right now, Wike has scattered the internet with his fantastic dance steps, serenading with ‘On Your Mandate we Stand,’ the renowned National Anthem for the progressives. Many haters have been boiling, saying, ‘See PDP man,’ but who no like better thing? Wike na one person wey like better thing.

Why Wike no go enjoy the friendship wey e don find with Jagaban and hin new allies? E be like Bolanle wey her boyfriend treat am like second-class side chick after all the effort wey she do for am. Listen to Zlantan’s song just in case you no sabi the lyrics of the jam.

Advertisement

“Bolanle get boyfriend…wey dey misbehave. She get boyfriend…wey no like to spend oh. She get boyfriend…he too dey kaku. She get boyfriend omo Ijebu eh.”

Na so Wike been dey sponsor PDP for over eight years, only for dem to betray am as Atiku come out as the presidential candidate and retain Iyorchia Ayu from hin own region as National Chairman.

Now, all the way from PH to Abuja, Wike don see good paddy for the esteemed Bola Ahmed Tinubu. Who no like better thing?

Just like Bolanle, “All the way from Epe to Lekki. Bolanle don turn person…Bolanle don turn person wey dey buy Hennessy sef for person. Bolanle ma ti gbera…Bolanle ti je jackpot.”

Advertisement

Oya, Wike, pepper dem oh! Who no like better thing? Wike like better thing. See as you dey watch this video carry put ear phones then speakers for BACKGROUND go play Bolanle ft Zlantan, IVD, make sure say you loud the volume and enjoy an awesome experience and thank me later.

Osigwe Omo-Ikirodah is the Chairman and CEO of Bush Radio Academy.

Source: iReporteronline

Advertisement
Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x