Connect with us

Latest News

Omo Na Better Follow Come: Dennis Idahosa Projects No Get Part 2

Published

on

299984704 627751005376624 7046286970634768141 n

Omo Na Better Follow Come: Dennis Idahosa Projects No Get Part 2

Dennis Idahosa and Project, e be like “follow come” for Naija o! If you hear “follow come,” e mean say na original, na brand-new wey dem carry come straight from the manufacturer. E show say the thing pure, e no get wahala, and e neva see hand wey fit spoil am since e waka commot for factory.

People dey use “follow come” to talk say this thing na correct, e pure, e original. Dem dey use am show say no be tokunbo or fake something. Na to talk say e still dey the way wey dem produce am from the beginning.

Dennis Idahosa, our lawmaker wey dey represent Ovia Federal constituency for NASS, don show us say him na true “follow come” when dem dey yan about projects. This guy don show say e sabi better thing as him don carry out plenti projects, reach level wey e constituents sef no fit count again.

Advertisement

If you check health matter, Dennis don build health centers  wey dey cari better treatment come. For education, e no carry last at all, as schools for hin area don dey shine with better facilities and learning wey go make pikin brain grow.

No forget bridges and roads, Dennis Idahosa don show love for hin people as him don build bridges wey make movement easy, plus roads wey dey make sense.

Skills too no carry last for hin agenda, as Dennis don empower hin people with better skills wey go fit help dem find better work and make life beta.

Na so Dennis dey run things, e no dey slack. If you check, na so people dey call am Mr. Project for Edo State, because the man and projects, na like five and six.

Advertisement

Precious Adaeze writes in from Benin City.

 

Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x