Latest News
PDP Lagos Rally And LP Taraba Rally: Pictures That Atiku And Obi Would Not Show You(Hilarious Post)
PDP Lagos Rally And LP Taraba Rally: Pictures That Atiku And Obi Would Not Show You(Hilarious Post)
Today we go take una through the rigours of electoral campaigns and na in our local dialect we go take gist una, I hope say una like “proverbs” sha because this matter deep well well and na only through wise sayings we go fit pass our message.
Craze no hard to form,na the trekking be the wahala , so to contest for president no be the problem na to begin go rallies and campaigns make we see weda you really get fans or not.
My people say no be who first pull shirt dey win fight, before INEC blow whistle for campaign some political parties wey say dem be “MOVEMENT” come begin dey run kiti kata, dam no let us hear word for town.
Everyday we go dey hear one million man rally, two million man march, five million man solidarity walk. But INEC don blow whistle now make campaign start wahala don enter. Dam say na pikin way the mama carry for back na go tell you say journey no far , even if the mama Trekk 50 kilometers.
So PDP and Atiku do their presidential rally for Lagos and LP with Peter Obi do their presidential rally for Taraba and forget picture why dem show una, the crowd empty finish.
Atiku Lagos rally be like marriage introduction. You know say introduction for marriage na only family members dey attend with one or two close friends.
Atiku was even waving at an empty stadium , the snake way bite Atiku na take d same tail flog Peter Obi , the LP rally for Taraba State beta pass Lagos own small, the LP own be like child naming ceremony.
Weda yansh face east or west, na still back e go dey, so if you like jump from PDP Lite to PDP Promax where you dey na you day, that is what we call structure.
Person wey borrow cloth go party no dey dance too much, Musa Kwankwaso of NNPP how many times you don see am go rally? Because him know say no matter how Lizard dey do press up, e no go get chest like Aligator.
See make I tell una, I get am before No be property , PDP don fade and with wetin Nyesom Wike dey take their eyes see na only pity I just day pity dem, water wey dem use take make eba can never be recovered back. PDP don shit for market square and their bluff of the G5 governors na go be their Waterloo.
My people say na for old age ashawo dey know the value of pikin, na when election reach na politicians go know wettin be structure, that na why u go see Peter Obi day run go all the crusade wey dey take place make e for fit get endorsement from the church.
But the truth be say, take RCCG for example if Baba himself, Adeboye contest for President RCCG members wey go vote am sef go be handful. Vote no day inside church oh, these people no day vote like as dem dey do fasting and prayers oh.
The truth is that they all have their own personal interest when it comes to voting they are highly independent, and this is a compliment not a slight.We christians are proud independent voters.
So Na d amount of maggi and seasoning wey dey inside pot of boiling meat they determine how d aroma go be, the way you take get structure and how you take plan na go determine your performance for the polls oh.
Breeze don blow now fowl yansh don open, Peter Obi don abandon him Northern rallies while Atiku dey get zero crowd for him South-West rallies. We even hear say Atiku don tell Jandor make e refund money wey dam take mobilize people.
You know say I no gree… I no gree na dey tear cloth? Shey una see the trending video wey PDP members dey vex say Lagos PDP na go destroy Atiku. These were members returning from the rally in their bus speaking out, it was that bad.
Now na every mallam with em own kettle,every aboki with em own radio, the three PDP Musketeers of Peter Obi, Musa Kwankwaso and Atiku don share support like this so, things don fall apart and the centre no fit hold again.My thing and our thing no be the same oh.
E get one post why I see for Facebook by Prince Teriba where he said” Mr. Peter Obi was welcomed by empty seats in Taraba Republic…This is what you get when you are a social media President.”
If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury, Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
Woman wey never see problem… Na im dey still hold breast run, the coming days would tell us more how the electoral process would shape up, dam say person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
So PDP Lite, PDP Promax and PDP XR should sit up for the challenges ahead , akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem different.
Oya make una see the pictures wey PDP and LP no go ever show you for their rallies for Lagos and Taraba states.
My name na Osigwe Omo-Ikirodah and na me b d Principal SLASH CEO of Bush Radio Academy.
Copyright protected.
Source iReporteronline.
-
Latest News2 weeks agoTinubu Announces New Appointment, Sends Nominee To Senate For Confirmation
-
Politics1 week agoBREAKING: Tinubu Inaugurates New Ministers
-
Politics2 weeks agoWike Clears Air On Chinda, Says INEC Candidate List Drops In July
-
Latest News1 week agoINEC Drops Final List Of Candidates For June 2026 Bye-Elections
-
Latest News6 days agoAbubakar Momoh Engages CCECC President At Global Infrastructure Forum In China
-
Latest News2 weeks agoPolice Provide Fresh Update On Release Of Abducted Oyo Pupils, Teachers
-
Politics3 days agoAPC Rules Out Any Review Of 2027 Primary Election Results
-
Latest News3 days agoObasanjo Teases Abdulsalami: “I And Gowon May Not Be Alive When You Hit 100
-
Entertainment2 weeks agoLove In Ghana! Peller Proposes To Jarvis As Romantic Video Goes Viral
-
Sports2 weeks agoArsenal Announce Exit Of 15 Players As Contract Discussions Continue With Three Others
-
Latest News4 days agoKidnap Suspects Reveal How They Abducted Adelabu’s Sister And Twin Sons
-
Latest News2 weeks agoFresh Court Decision Emerges In ADC Leadership Battle

