Connect with us

Latest News

Edo PDP Don Fall Yakata: 30 Leaders Carry Waka One Time(Photos)

Published

on

a1 scaled

Edo PDP Don Fall Yakata: 30 Leaders Carry Waka One Time(Photos)

E don set for PDP as 30 of dem big big leaders don resign pata pata. As dem waka comot, dem talk say no be small thing wey dey happen for PDP. Obaseki dey catch woto woto as dem yarn all the tori wey make dem leave. Dem say di man no sabi keep promise, him dey do as if him no get ear, and di person wey him wan hand over power to be like stranger for dem eye. Di matter no funny at all!Obaseki Promise But No Deliver.

Dem talk say Obaseki just dey promise anyhow, but when e reach to do the thing, na story full ground. One of the leaders wey resign say, “How person go talk say e go build bridge even where river no dey? Na so Obaseki take dey fool us since.” Di thing pain dem well well.

Anointed Successor Weh Dem No Know

Advertisement

Another reason wey dem give be say, Obaseki wan make one kponkious stranger him successor. Dem say, “Who be this one sef? We no know am, e no sabi us, we sef no sabi am. How we go take trust am?” E be like say na from strange land dem carry di person come.

Obaseki No Dey Hear Word

Plenty of di leaders talk say Obaseki no dey hear word. “If you talk one, e go talk ten. How person go take lead like that? Na so so insensitivity dey worry am.” Dem say even when dem advise am, e no dey listen. Na wetin vex dem pass be that.

Edo PDP Don Fall Yakata

Advertisement

“Di ‘P’ for PDP don waka, e remain DP,” na so APC leader wey dem dey call Prince Igbinedion take laugh dem for him Facebook page. Di thing no be small matter. Dem take style pepper PDP well well, make dem know say wahala don burst. Dem even carry foto put am for social media, make everybody see say e don happen.

Wetin Go Happen Next?

Everybody dey wait to see wetin go happen next. PDP for Edo don lose plenty ogbonge people, and e be like say na now di real kasala go burst. As e be so, PDP go need serious miracle to fit recover from dis gbege wey don land for their head.

Make una grab una popcorn, siddon gidigba, and watch as di drama go unfold. Di matter dey pepper PDP, and na who dey laugh last go laugh best. E don red for PDP! No b lie PDP don collect badly today as full 30 Billion gang na comet for their party so.

Advertisement

Na me Osigwe Omo-Ikirodah of Bush Radio Academy fame na dey bring dis ogbonge tori.

See photos dem make you no say no be film trick.

a1 1 448880503 10228685683761110 1816116916736142636 n 2 448740267 10228685696841437 5169056645679123468 n 448695070 10228685682801086 6938272806975889233 n 448742855 10228685696721434 3762257650524098553 n 448828823 10228685694961390 3818592654216424072 n 448740997 10228685694801386 4551591576406729863 n 448829663 10228685694521379 679522054972935396 n 448827680 10228685693121344 8697294808284706522 n 448829672 10228685692161320 7310003091559571132 n 448880118 10228685689601256 7386375604590357394 n 448880634 10228685688361225 3568919627468360434 n 448829153 10228685687081193 1044293161586882651 n 448881405 10228685685961165 5635288515614016343 n 448833752 10228685685121144 5190655458511240267 n

Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x