Latest News
2023: If We Must Salvage Nigeria, Na Be Say Na Tinubu We Go Support By Osigwe Omo-Ikirodah
2023: If We Must Salvage Nigeria, Na Be Say Na Tinubu We Go Support By Osigwe Omo-Ikirodah
Today mata na serius mata, we need to discuss solemnly on how Nigeria wan take overcome all these challenges wey dey face us korokoro for we eye so.
You know say most times Nigerians go just like to dey spread fake fake news say the country don dey completely overtaken by bandits, terrorists, hoodlums and vagabonds in power etc.
We know say Nigeria really dey critical situation but wetin be the solution? Our politician’s don fail us, Our clergies don fail us even our parents’ wey say dem go stand by us make we Excel don go siddon for corner sake of say dem don stand, dem don tire.
Before I talk much I go explain few things to una, you see most of these people wey dey form say dem dey champion our courses na Fugazi dem b , actually na just a means to an end to reap the common man off.
Our religious leaders and ethnic champions of liberation wey say dem dey fight for our rights na mostly scam. They are there just to enrich themselves at the detriment of their followers.
Are you aware today that a general overseer in a big church wields more power than even the president? E shock you abi? No b lie my General Overseer, for example, him followers dey worship am like God, dem see am like saint and dem ready give their blood for am. These people are living their lives without checks and balances at the expense of their congregation.
So my point, first of all, be say before you criticize your leaders you don ask yourself how your Pastors, Imam’s and native priest dey manage una sacrifices wey una dey perform to make their ministry grow?
Then all these people wey dey say na dem be Biafra champions, Oduduwa liberators and Arewa defenders and co na dem worse pass. These ones dey live like say na dem BORN GOD. Their people dey worship dem like say na dem create Heaven and Earth. Their words are final and dem no even dey tolerant mistakes from their followers. They treat some of these followers like slaves.
Now if we establish the fact say even aside from Government position our local leaders and mentors are not saints then let us siddon make we really look how we go fit to take salvage our country.
2023 don dey around the corner and we get no time again to experiment with people wey never fit prove themselves with leadership positon before or wey no get good pedigree.
So among these same recycled politicians wey we get who amongst them really get the native intelligence, diplomatic intelligence, patriotism, competency, transparency, sincerity and commitment to really solve our problems?
So let us ask ourselves who are the likely presidential aspirants from North to South? From East to West? It is either a serving governor or past governor. So since every likely contestant has an antecedent with Governance can we for Pete’s sake take a break and compare and contrast? Of all the likely presidential aspirants only Atiku happens not to fall in that category as serving or an ex-Governor.
Wetin these people achieve for their respective States when dem serve as Governor or as dem they serve as Governor currently? What institutions did they establish that is still flourishing to date? Their so-called master plan for their State how well e dey go today?
But we want to change and we no want tell ourselves the truth? Of all these people wey wan come out who don outperform Lagos State and the legacies left behind by Asiwaju Bola Ahmed Tinubu?
If Nigeria begin work like Lagos State and we start from there na Bad Thing? Lagos State is the fifth largest economy in Africa and one of the fastest-growing megacities in the World.
See if Tinubu be president na b say e don take charge himself no be advise e go dey give again. Na him go by himself govern us. E don turn the driver b dat no more passenger tinz.
Tinubu na patriotic man, the man for fit choose to be regional leader make dem dey worship am na god with a SMALL g. But the man want to contribute him quota make Nigeria for beta.
Look around my brothers and sisters who among all these same politicians get beta experience reach the Jagaban? Which of them fit control people wey dem go listen to them? One thing na to give order another thing na to implement the order. Tinubu has the will power to transform Nigeria and we must give am that chance if we sincerely want make Nigeria pure.
Na who dey give dey spread love o, no b by who get money pass. Make we shine our eyes well well my people and make we critically analyze which of all these leaders don outperform Tinubu. If any of such leaders dey my people i no go deceive una make una vote the person.
But from wetin me dey see so Asiwaju Bola Ahmed Tinbu no get match amongst these potential aspirants.
For us at Tinubu Vanguard we believe say na Tinubu get the solution to Naija problems especially Insecurity (priority), economy, corruption, unemployment, health care, comprehensive and qualitative education etc.
Make we support who get the right leadership qualities BIKO. Tinubu towers above all others.
Osigwe Omo-Ikirodah writes in from Lagos.
Copyright 2021.
iReporteronline notifies users that Osigwe Omo-Ikirodah is the owner of the copyright: All Rights Reserved.
Whatsapp 07032341798
Facebook.
https://www.facebook.com/osigwe.ikirodah
-
Latest News2 days agoOlisa Metuh, Tunde Rahman, Abike Dabiri, Others Appointed As Tinubu’s Renewed Hope Ambassadors
-
Latest News2 weeks agoSh*ck Move: Cameroon’s President Biya Names His Son Vice President
-
Latest News2 weeks agoPresidency Fires Back At ADC: ‘We Won’t Close Shop Because You’re Struggling
-
Latest News6 days agoIyabo Obasanjo Responds As Senator Yayi Emerges Ogun APC Consensus Candidate
-
Latest News1 week agoIt’s Obvious I Don’t Own What You Have” – Lamido Blasts Malami Over ‘Thief’ Claims
-
Latest News2 weeks agoAPC Blocks Bala Mohammed’s Defection — Here’s Why
-
Latest News2 weeks agoA Birthday Fit For A Legend : Watch Abubakar Momoh Make A Grand Entrance At Adams Oshiomhole’s Residence
-
Latest News2 weeks agoKeyamo Slams Peter Obi, Kwankwaso: ‘They Think They Can Blackmail Everyone
-
Latest News1 week agoTony Akiotu Has Been Appointed As The New Chairman Of The Broadcasting Organisations Of Nigeria
-
Latest News2 weeks agoSh*ck Exit: Akinwumi Steps Down As ADC Secretary
-
Latest News22 hours agoADC Crisis Worsens As Binani Allies Defect In Adamawa
-
Latest News5 days agoWhy We’re Tolerating Wike – APC Chair Yilwatda Speaks Out

