Connect with us

Latest News

Follow Who Know Road: Watch As Osinbajo Declares Tinubu As The Greatest Transformative Leader Ever (Must See Video)

Published

on

Vice President Yemi Osinbajo SAN represents President Muhammadu Buhari as the Special guest of honor at the annual Nigeria Army Day Celebration in Ikeja Cantonment Lagos 1

Follow Who Know Road: Watch As Osinbajo Declares Tinubu As The Greatest Transformative Leader Ever (Must See Video)

Follow who know road o oga…Follow who know road o
Abobi follow who know road o, i bu dike…..Follow who know road o

When I go east some days ago na this song dem wan use deaf person ear. Everywhere the song dey blaze, follow who know road by Onyenze.

The sweetest part for the song na the verse wey say” My mama tell me say , Onyenze follow who know road…

Advertisement

Because if you follow who no know road…You go suffer, so tey you go tire…You go waka, so tey you go tire…. Obodo ndi isi, onye ofu anya bu eze.”

Vice President Yemi Osinbajo SAN represents President Muhammadu Buhari as the Special guest of honor at the annual Nigeria Army Day Celebration in Ikeja Cantonment Lagos 1

This trending video of Vice President Osinbajo giving full credit to Tinubu as a Master leader na clear case of FOLLOW WHO KNOW ROAD.

Osinbajo finish work for the video, the Professor sabi speak grammar sha , with him smooth voice Osinbajo come take him time to explain how Tinubu be the best leader wey sabi shop for talents irrespective of the tribe wey dem come from.

Osinbajo talk sha, he explain how Jagaban pick am from Ogun State, Aregbesola from Osun State, Lai Mohammed from Kwara State , Ben Akaubeze from Anambra State and so many others.

Advertisement

Osinbajo even talk how Tinubu take appoint Judges from every corner across the country.  Just picking the best people no matter where dem comot from.

He praise Tinubu to the end, where Osinbajo finish work for the video na when he talk say Nigeria dey gifted to get one of the greatest transformative leaders in Tinubu.

The vice president come end him speech with prayers. I know say dem go dey ask me when this one happen.

Oga make una follow who know road oh, make una no miss road for 2023, Osinbajo don first talk before say Tinubu na the man wey know road.

Advertisement

See the video for yourself, truth no dey break teeth.

 

 

 

Advertisement
Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x