Connect with us

Politics

Obidient Couple: See Wetin Husband And Wife Wear Go Church Wey Dey Scatta Internet Upadan (Photo) 

Published

on

photo 2022 08 08 19 49 37

Obidient Couple: See Wetin Husband And Wife Wear Go Church Wey Dey Scatta Internet Upadan (Photo)

These Obidient people really get different Ogbonge ways wey dem take dey sell Peter Obi with style sha. On Sunday this husband and wife wear Obidient 2023 T-shirt go church and since then go reach now we no dey hear word for social media.

You know say these coming general elections many people don talk say na personality of individual candidate dem go look and no be political party again, dem dey argue say the political parties don fail us and na him make Nigeria don dabaru so. According to these Nigerians wey e b say na dem dey majority, time don reach wey e b say dem go try different style make dem see if WE country go get head again.

Now d Peter Obi movement come be like the alternative to all these failed and recycled leaders wey dem dey bring come out for we eyes. So d way the youths and other meaning Nigerians come carry the matter for head dey surprise, everybody.

Advertisement

This time around dem come out well well come register to vote, so tay the youths come make up 71.4 % of the newly registered  over 12 million votes.

For their mind na dem b d structure and this time around dem ready to come out to participate for the electoral process, so dem go fit  beat their chest say yes Nigeria go better again.

Nigerians don wake up oh and na all the opportunities wey dey their hand dem take dey campaign for Peter Obi so, see the trending PHOTO below make u sef comment put.

Osigwe Omo-Ikirodah

Advertisement

Principal Bush Radio Academy.

Copyright protected.

 

 

Advertisement

photo 2022 08 08 19 49 37

Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Inline Feedbacks
View all comments
Advertisement

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x