Connect with us

Latest News

Saliu Mustapha Don Scatter Kwara With 200 Million Cash Empowerment Donation (Photos)

Published

on

278895066 5429384147073037 2506485820656205549 n

Saliu Mustapha Don Scatter Kwara With 200 Million Cash Empowerment Donation (Photos)

Na dis one we dey call MEGA SPLASH, that is Ogbonge give away, the first of e kind ever. 200 Million Naira Cash Give-Away.

Abeg yesterday Mallam Saliu Mustapha scatter everybody expectations as him give out 200 million Naira cash to 600 Kwarians make dem take boost their business.

The thing b like film trick for everybody eye as Mallam begin give out 200k and 500 k cash to beneficiaries.

Advertisement

The shocking aspect b say Mallam Saliu Mustapha foundation run the shows through a very transparent and pure manner.

One single discrimination no dey inside as dem arrange 25 Development Associations across the five (5) local government areas of Ilorin Emirate under the main body wey dem dey call IEYDA take run the process wey dem take select these people wey need this blessing badly.

Like this so, Mallam don lift 600 people comot from abject poverty overnight.

No wonder E people for Kwara Central don dey shout since say make him come contest the Kwara Central Senatorial district since him step down from the National convention wey see Adamu Abdullahi emerge as the APC National Chairman.

Advertisement

Anyway, we thank God say Chairman don accept the call to service, na God na go bless Saliu Mustapha plenty, that Kwara Central Senatorial seat so God don sign am already for am.

Saliu Mustapha na good and godly man. Kwara people say this na the first time for their existence this kind thing don happen for their state, me sef feel say e never even happen anywhere before if you know abeg let us know.

The event take place for Kwara Banquet Hall and the place full reach roof. See the awesome pictures from the event.

278863035 5429384557072996 5779411655053722997 n 278863116 5429384247073027 4949746714515915091 n 278870637 5429384403739678 7151098906301390529 n 1 1 278870637 5429384403739678 7151098906301390529 n 278872737 5429384083739710 8023666177618101421 n 278875044 5429384330406352 8317848134922832359 n 1 278877843 5429384497073002 8963245341632953405 n 278882377 5429383627073089 4844959939498630282 n 278895066 5429384147073037 2506485820656205549 n 278900747 5429383937073058 8060638609547005630 n 278908064 5429384027073049 7196784823315726335 n

Advertisement
Advertisement
Click to comment
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Trending

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x