Latest News
Saliu Mustapha Don Scatter Kwara With 200 Million Cash Empowerment Donation (Photos)
Saliu Mustapha Don Scatter Kwara With 200 Million Cash Empowerment Donation (Photos)
Na dis one we dey call MEGA SPLASH, that is Ogbonge give away, the first of e kind ever. 200 Million Naira Cash Give-Away.
Abeg yesterday Mallam Saliu Mustapha scatter everybody expectations as him give out 200 million Naira cash to 600 Kwarians make dem take boost their business.
The thing b like film trick for everybody eye as Mallam begin give out 200k and 500 k cash to beneficiaries.
The shocking aspect b say Mallam Saliu Mustapha foundation run the shows through a very transparent and pure manner.
One single discrimination no dey inside as dem arrange 25 Development Associations across the five (5) local government areas of Ilorin Emirate under the main body wey dem dey call IEYDA take run the process wey dem take select these people wey need this blessing badly.
Like this so, Mallam don lift 600 people comot from abject poverty overnight.
No wonder E people for Kwara Central don dey shout since say make him come contest the Kwara Central Senatorial district since him step down from the National convention wey see Adamu Abdullahi emerge as the APC National Chairman.
Anyway, we thank God say Chairman don accept the call to service, na God na go bless Saliu Mustapha plenty, that Kwara Central Senatorial seat so God don sign am already for am.
Saliu Mustapha na good and godly man. Kwara people say this na the first time for their existence this kind thing don happen for their state, me sef feel say e never even happen anywhere before if you know abeg let us know.
The event take place for Kwara Banquet Hall and the place full reach roof. See the awesome pictures from the event.
-
Latest News7 days agoTinubu Govt Declares Nationwide Public Holiday For Nigerians
-
Entertainment5 days ago₦800,000, ₦5m, $11,000: Ogogo’s Daughter Accuses Nigerians Of Exploiting Father’s Cancer
-
Latest News1 week agoTinubu Meets Akpabio, Doguwa, Oyetola, Alake At Aso Rock
-
Latest News2 weeks agoINEC Makes Fresh Announcement After Declaring Adeleke Winner Of Osun Election
-
Latest News6 days agoAPC Chairman Collapses, D!es
-
Latest News4 days agoUzodinma Won’t Market Tinubu To Igbos’ – Oshiomhole Reveals Who Should Help
-
Latest News4 days agoTinubu Renews Appointments In NTA, NAN
-
Latest News3 days agoFG Announces New Appointment
-
Entertainment1 week agoOgogo’s Family Breaks Silence, Debunks Viral D**th Rumour
-
Gist2 weeks agoYour Uncle Adeleke Is The Real Arindin’ – Sowore Fires Back At Davido
-
Latest News3 days agoTinubu Reviews APC Campaign Council Over ‘Corrupt’ Names — See Who Escaped the Shake-Up
-
Latest News2 weeks agoOsun Election: INEC Gives Fresh Update As Voting Continues
